a woman's prayer

Wednesday, November 29, 2006

i miss my identity

Na wa o! I cant seem to find anything else to do to make up for my lack of friends and work. All i do day in day out, is take of my little darlings and go shopping am beginning to loose my identity!! I had a discussion with this chinko woman that has a son at my baby's nursery and all we talk 'bout was food and chinese eatries. Na this one kon make me think i bin dey loose touch i need to get me self a job in the newyear or enroll for college make i start to build some connection with the world out there. Husby's bro never come as he promised i for don waka comot go look for deals.......men can be abit unreliable. I suppose take stock of wetin i don achieve this year but fear no gree me and na the only way i go fit correct my mistakes be that. Still planning to go Nija next year but damn only God sabi wetin go sele for that obodo Nigeria after elections next year, atleast i go try go see my pple before the idigbo period. I don miss my sisters and T my friend i hope say she don tone down her make-up disaster ( i mean disaster) she is one of those girls who go the extra mile with black eye pencils and eyebrows!anyways i still miss my gurrl. My paddy J dey go lagos for xmas, i can only envy her gone are the days when babe fit do as i please now i got to pack for three babies and husby how for do man go survive.

0 Comments:

Post a Comment

<< Home