a woman's prayer

Wednesday, February 14, 2007

JUST PLAIN LAZY

Wetin do me, kilosele? na so i do over two solid months before babe blog! believe it or not i have been visiting other blogs but i refused to pen my thots. E be like say omo gurl don dey turn lazy. Its fasting and praying time now and am seeking God's help with my job search hopefully i'll be giving my testimonies soon.
On a lighter note na so i give taye and kenny sweets( soft ones) before i get all this lookuman wey go feju mo mi! my cute taye go sit down for one corner dey gbadun the sweet u know those kids that eat slowly enjoying every bit of it, na ehm kenny rush ehm own con go fix him finger for taye bobo mouth that one give am nko ti oju ole ma'ri( put lightly, T bit K's finger) the finger just swell become red, i ran cold water untop the hand for like 10 mins my son still dey cry na ehm everybody laugh am o. E don dey do this kin chancing since dem start to move, but T just decide to show am say 3mins senior na senior anyday anytime.
Our travel plans fell thru after we had a lot of drama in january with the kids falling ill and baba ibeji no wan carry precious darlings go home country go expose dem to orisirisi( in his words).
Make i go start to cook ewa ibeji cos na him my peeps go eat go sleep. Fingers crossed i no go take another 2months to update again.

0 Comments:

Post a Comment

<< Home